Sweet Mother - Prince Nico Mbarga/Rocafil Jazz International
Sweet mother I no go forget you
For dey suffer we you suffer for me yeah
Sweet mother I no go forget you
For dey suffer we you suffer for me yeah
When I dey cry my mother go carry me
She go say my pikin wetin you dey cry yeah yeah
Stop stop stop stop stop stop
Make you no cry again ohhh
When I wan' sleep my mother go pet me
She go lie me well well for bed
She go cover me cloth say make you sleep
Sleep sleep my pikin oooo
When I dey hungry my mother go run up and down
She dey find me somthing we I go chop
Sweet mother sweet mother ohhhh
When I dey sick my mother go cry cry cry
She go say instead wey I go die make she die
She go beg God God help me
God help me my pikin oo
If I no sleep my mother no go sleep
If I no chop my mother no go chop
She no dey tire ooo
Sweet mother I no go forget dey suffer
Wey you suffer for me yeah yeah
Sweet mother
Sweet mother ohhh
Sweet mother I no go forget you
For dey suffer we you suffer for me yeah
Sweet mother I no go forget you
For dey suffer we you suffer for me yeah
When I dey cry my mother go carry me
She go say my pikin wetin you dey cry yeah yeah
Stop stop stop stop stop stop
Make you no cry again oo
When I wan' sleep my mother go pet me
She go lie me well well for bed
She go cover me cloth say make you sleep
Sleep sleep my pikin oooo
When I dey hungry my mom go run up and down
She dey find me somthing we I go chop
Sweet mother ehhh sweet mother ohh
When I dey sick my mother go cry cry cry
She go say instead wey I go die make she die
She go beg God God help me
God help me my pikin oo
If I no sleep my mother no go sleep
If I no chop my mother no go chop
She no dey tire ooo
Sweet mother I no go forget dey suffer
Wey you suffer for me yeah yeah
Sweet mother ehhh
Sweet mother ohhh
When I dey hungry my mom go run up and down
She dey find me somthing we I go chop
Sweet mother sweet mother ohh
When I dey sick my mother go cry cry cry
She go say instead wey I go die make she die
She go beg God God help me
God help me my pikin oo
If I no sleep my mother no go sleep
If I no chop my mother no go chop
She no dey tire ooo
Sweet mother I no go forget dey suffer
Wey you suffer for me yeah yeah
Sweet mother
Sweet mother ohh
Sweet mother
Sweet mother
Sweet mother
Sweet mother ehh